Lazy lazy I am that lazy
Make you-na listen
I am that lazy
You talk am yourself
No be lie mr prezi
Spend months for London
I be that lazy
Ask Naija why she lazy
My guy talk am
Him say you lazy
Kabiru wan be doctor
Naija turn am to farm tractor
Tunde wan be accountant
Naija make am dey work for restaurant
Aysha wan be lawyer
Now na Acara She dey fry so far
Naija Naija my beautiful Naija
Why all the wahala
I be your brotha
Talk to me my brotha
Make we invite the sistas
Discuss dis tin wey de hold us back
Our future from the start
From north to the south
Our vision done dey drop
Oboy, this rainfall no go stop
Open your mind and talk
Tell devil make him walk
This body no be shop
My beautiful Naija we have seen and saw
The beauty wey them draw
A beauty like the ocean
so natural and pure
Shha….🤦🏽♂️ [Deep breath],
we shall neva fall
till the end, it is me and you, my Naija.
© COPYRIGHT 2018. AHMAD ABDUL-ONE
💓💓💓
LikeLiked by 1 person